Judith Suminwa Tuluka profile: Former planning minister make history as DR Congo first prime minister

Wia dis foto come from, DR Congo Planning Ministry/X

Wetin we call dis foto,

DR Congo don appoint first-ever female Prime Minister

Democratic Republic of Congo (DRC) don get dia first-ever female prime minister.

President Félix Tshisekedi appoint Judith Suminwa Tuluka just months afta e assume office.

Ms Tulaka wey be di kontri former planning minister go replace Sama Lukonde wey resign for February.

Her appointment dey come afta long search for majority coalition for di National Assembly – wey be one key step bifor dem fit name a prime minister and form a goment.

Di prime minister dey head di goment, wey compose of ministers and deputy ministers.

« I know say di task dey great and di challenges plenti, but wit di support of di president and evribodi, we go get dia, » Ms Tuluka tok for one press conference on Monday afta her appointment.

Who be Judith Suminwa Tuluka?

Madam Tuluka na Congolese politician wey get ova 20 years of national and international experience for di field of democratic governance and peacebuilding including security governance.

Bifor she enta DRC parliament, Tuluka na economist wey work for di United Nations Development Programme (UNDP) as di coordinator for di Consolidation of Peace and Strengthening of Democracy pillar for Congo national capital Kinshasa.

For 24 March 2023, dem appoint her as di Minister of Planning for DRC.

Bifor her appointment as di Minister of State in charge of Planning, Ms Tulaka bin serve as di Deputy Coordinator, in charge of administrative and operational issues of di Presidential Strategic Monitoring Council (CPVS).

According to her bio on di Planning Ministry website, di prime minister get master’s degree in Labour Sciences – Administration and personnel management. She get degree for applied economics. She also be graduate of accounting from di School of Promotion and Continuing Education (EPFC) for Brussels.

Regarding her professional skills, Madam Tulaka na senior expert in international development wit experience in different national contexts and experience in change management.

She be expert in formulation and development programs, coordination, strategy management, budget monitoring and program monitoring and evaluation.

Di new prime minister go dey tasked wit pushing priorities di president bin declare, wey include employment, youth, women and national cohesion for di kontri of about 100 million pipo.

She dey expected to form new cabinet in di coming week.

According to di United Nations, about seven million pipo dey internally displaced sake of di kasala for DR Congo. E also be one of di world poorest kontris.

Crédit: Lien source

Les commentaires sont fermés.