Wizkid mum burial: Afrobeat star Wizkid: Wizkid bury im mama for Lagos

Wia dis foto come from, @ENIOLA_BADMUS/INSTAGRAM, @TOOLZO/X

Nigerian celebrities gada to show support to Afrobeats star, Ayodeji Balogun, wey pipo dey call Wizkid as im bury im mama for Lagos on Friday.

Wizkid mama, Dolapo Balogun, die at di age of 66-year-old for London on 18 August 2023.

Di deceased born four pikin Yetunde, Omolara, Olubusayo and Ayodeji and she get nine grandchildren.

Di funeral service bin hold for Redeemed Christian Church of God (City of David), Victoria Island on 13 October.

During di church ceremony Wizkid ask God make im take away di pain of di lost wey dem suffer due to im mama death .

“I no get words to describe di pain way I dey feel, and I know say evri member of my family dey feel di pain wit me, » di ogbonge musician tok.

On Friday, many Nigerian celebrities gada to sympathise wit Wizkid, as dem show support during di church service and funeral party for di woman burial.

Di Afrobeat star, Wizkid na di only son and last born to im mama. Afta di death of im mama, Wizkid stay away from social media.

Di celebrity for im 2014 album “Ayo” sing one song, “Mummy Mi” to show im love for im mama.

One of di celebrities wey show face for di burial na Fuji icon King Wasiu Ayinde Marshal wey pipo also sabi as KWAM 1.

For one video wey bin go viral on social media, di Fuji icon bin dey sing for Wizkid as pipo gada dem dey jolly.

Skip Twitter post, 1

Allow Twitter content?

Dis article contain content wey Twitter provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Twitter cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose ‘accept and continue’.

Wetin we call dis Video, Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of Twitter post, 1

Ogbonge Nollywood actress Eniola Badmus also show face for di ceremony and she share videos and fotos of herself wit Wizkid ontop her social media page.

Skip Instagram post

Allow Instagram content?

Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose ‘accept and continue’.

Wetin we call dis Video, Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of Instagram post

One video show as Wizkid no fit hold im tears wey flow as di funeral service bin dey go on.

Skip Twitter post, 2

Allow Twitter content?

Dis article contain content wey Twitter provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Twitter cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose ‘accept and continue’.

Wetin we call dis Video, Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of Twitter post, 2

Oda Ogbonge celebrities for di entertainment industry like, Dbanj, Tiwa Savage, Mercy Eke, Banky W, Wande coal, Rudeboi, Kim Oprah and Osas also attend di event.

Also, business guru Tony Elumelu and traditional ruler, Elegushi of Ikate-Elegushi Kingdo, Ademola Saheed Elegusi also attend di event.

Business and entertainment celebrities show support as dem dey spray moni and hug Wizkid for di funeral ceremony

Also, Wizkid fans bin send am support and love ontop social during im mama burial. Many pipo dey praise am for im courage to bear di pain.


Crédit: Lien source

Les commentaires sont fermés.