Wia dis foto come from, INSTAGRAM/DAVIDO ADELEKE
Ogbonge musician Davido Adeleke aka Davido don share im testimony of welcoming twins wit im wife Chioma.
For UnitedMasters SelectCon 005 wey hold for New York Terminal 5 Venue on 14 October, Davido tok say im and Chioma bin dey shake wen dem find out say dem dey expect twins.
Di ogbonge artiste also make reference to dia late son Ifeanyi wey dem lose for October 2022 year and add say dem welcome twins for October 2023.
Davido tok say wetin happun to im and Chioma fit make many pipo stop to dey believe in God but im still get faith and im get great team around am.
Dis dey come afta one video wey show Davido wit im wife Chioma with two babies trend for social media on Friday.
Dis na afta tori bin commot say di musician and im wife born twins.
Inside di video, Chioma siddon ontop wheelchair carry two babies – one wear pink and di other wear blue. E be like she dey comot hospital while a hospital staff wey wear stethoscope dey her side dey help her togeda with Davido.
Di pesin wey dey record say: » we dey get our first car ride, in grandpa’s – our first ride na Bentley. »
Di camera man, den go on to zoom inside di car wey show two car seats for di back of di car.
« Oya come on in », e tok as hospital staff and anoda pesin come carry di babies from Chioma enter di car.
Before dis video go viral, fans of di Afrobeat star bin react to one post by di musician for social media on Tuesday afta di musician bin tweet on Wednesday say ‘’Stop to circulate old picture thank you. »
Davido Tweet afta tori begin fly up and down say im wife Chioma don born twins for America.
Many pipo including some celebs bin don rush to congratulate di couple for social media.
One old photo of di couple for hospital even go viral as di news begin spread.
Di singer tweet be like e address di photo mata but many of im fans bin confuse as im no confam di tori if im wife don born or not.
Many pipo bin run wit di video wey show Davido and Chioma wit di two babies as confirmation of di tori of di arrival of dia babies.
Davido bin rebuke music producer Samklef, one of di pipo wey post di viral video wey show Chioma wit di babies. E tell am say make e delete di video.
Dis article contain content wey Twitter provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Twitter cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose ‘accept and continue’.
End of Twitter post
Most of di fans wey react to im post bin dey confused as some begin ask say weda im reference to di old pictures mean say di rumours na true?
Early dis year di singer confam say im don marry for interview.
Davido and Chioma marry afta dia son Ifeanyi die for October last year.
Afta Ifeanyi death, di singer bin take break from social media for months to mourn im son.
Im wife neva post anytin for social since di incident happun.
Since Davido return back online, im dey hardly post tins about im family.
Di last post im make about im family na for April 30, wey be im wife birthday.
For dat post, im say »Today I just want celebrate my right hand! My go to! Happy birthday baby @thechefchi ! God bless you. Your love dey timeless. Na forever thing I ASSURE YOU! » E tok with Wit three love emojis.
Davido na one of di biggest Afrobeat singers for di African continent, millions of pipo dey follow am for social media.
Wia dis foto come from, Getty Images
Crédit: Lien source


Les commentaires sont fermés.