MohBad autopsy result: Davido, Falz, Zlatan, Iyabo Ojo, BBNaija housemates all turn-up for candlight procession for Afrobeat singer

Di Nigeria Police say pathologists dem don complete di autopsy procedure ontop di deadi body of Ilerioluwa Oladimeji Aloba wey pipo know as Mohbad.

Informate from di Police for Thursday night tok say di result go soon dey ready and dem go make am public.

« Di Nigeria Police Force wish to inform di public say di autopsy procedure for Mr Mohbad don dey successfully completed, » police tok.

Remember say BBC Pidgin bin monitor how di bodi of Mohbad take comot from wia di police dig am out for Ikorodu come carry am go Lagos State University Teaching Hospital (Lasuth).

All dis dey happun as fans hold candlelight procession for Lekki area of Lagos, southwest Nigeria, to honour Mohbad.

Di procession start from Lekki Phase 1 Gate and end for Muri Okunola Park, Victoria Island, Lagos.

Na Mohbad management organise di candlelight procession and concert and many pipo including celebrities turn up to honour di late singer.

Celebrities including Davido, Falz, BBNaija housemates, politicians all turn-up for di procession.

Di management for di announcement wey dem share on Mohbad official Instagram account say di dress code for di candlelight procession and concert na white T-shit.

Wia dis foto come from, BBC News

Wia dis foto come from, BBC News

Di crowd dey sing and dance along to Mohbad songs as dem dey waka for road wia dem cause plenty traffic.

Skip Twitter post, 1

Allow Twitter content?

Dis article contain content wey Twitter provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Twitter cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose ‘accept and continue’.

Wetin we call dis Video, Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of Twitter post, 1

As all dis dey go on, tok-tok pesin for di Lagos State Police Command announce on im X account say dem don conclude autopsy and dem dey await result.

Skip Twitter post, 2

Allow Twitter content?

Dis article contain content wey Twitter provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Twitter cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose ‘accept and continue’.

Wetin we call dis Video, Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of Twitter post, 2

Wia dis foto come from, BBC News

Authorities dig out MohBad deadi body for autopsy

Wia dis foto come from, MohBad/Instagram

Investigation into di death of Nigerian Afrobeat star Mohbad bin start proper.

Di special investigation team wey include di Police and operatives of di Department of State Services (DSS) dig out Mohbad deadi body.

Di 27-year-old singer, wey im real name na Ilerioluwa Aloba, die for one hospital for Lagos, Southwest Nigeria on 12 September.

Di digging out of di young artist body dey happun afta tori also come out police don arrest di nurse wey attend to Mohbad wen dem carry am go hospital.

A special detachment of investigators wey come from di Force Headquarters, Abuja dey for Lagos to follow for di investigation.

Police tok-tok pesin for Lagos, Benjamin Hundeyin post for X say ‘Exhumation completed’

Wia dis foto come from, Lagos Police/X

Plenty fans of Afrobeats star MohBad, wey die last week enta streets to demand for justice.

Peaceful protests for di late Nigerian singer happun for different states across Nigeria.

Musicians, celebrities and influential pipo from around di world don pay tribute to di late singer and rapper.

Dem describe im death as shocking and very painful. Most of dem praise im talent, tok about im pains and some share memories of di time dem spend wit am.

Some pipo wey mourn im death tok say dem no know am but dem dey vibe to im songs steady.

Protest, Ban on Naira Marley songs for radio stations & oda tins wey don occur since di death of Mohbad

Wetin we call dis foto,

Pipo dey march to demand for justice for Mohbad hold across southern Nigeria

Di hashtag #justiceformohbad don dey trend on X, former Twitter, since di musician death on Tuesday 12 September.

As pipo emotions dey high, some tributes bin suggest say di singer face bully within di music industry.

Most of di pipo anger dey particularly directed at im former boss, Naira Marley, wey e get disagreement wit afta e comot from di musician label – Marlian Records – last year.

Naira Marley himself wey im real name na Azeez Fashola don call for thorough investigation into MohBad death and e promise to assist wit « uncovering any foul play or injustice ».

However, wave of peaceful protests don dey spread across Nigeria to mourn di death of di rising star and to call for justice.

For Abeokuta di Ogun state capital, Southwest Nigeria, youths wey wear black clothes bin gada for di popular Panseke market for Abeokuta, dem carry placards wit inscriptions like #JusticeforMohbad, Justice for Mohbad”.

Youths for Akure, di Ondo State capital, also storm major roads within di area to protest di death of Mohbad

Lagos based fans and mourners for Ikate, Lekki and oda axis of di state also enta street to demand for justice as dem call on Nigerian Police plus oda security agencies to fish out im killers.

Im fans on social media say dem dey plan similar demonstrations for Kenya capital, Nairobi, and for London, UK.

Wetin we call dis foto,

Marches to demand for justice for Mohbad hold across southern Nigeria

Lagos state Commissioner of Police, Idowu Owohunwa don also beg di fans wey dey protest di death of di late artiste to give police space to carry out dia investigations.

E tok dis one wen e meet wit some Nollywood actresses wey visit di command on Wednesday 20 September to seek for justice for Mohbad.

“Give us space, if you trust us, no trigger anytin wey go remove our attention. Those pipo wey also no want justice fit trigger am. Allow police to get busy.”

Oga Owohunwa add say dem go provide proper protection for di family of di deceased. E say im don order di special unit to arrange correct protection for di family of Mohbad till all di investigations don dey successfully completed.

As plenti pipo dey point fingers to different celebrities wey video show say dem bully Mohbad wen im dey alive, di police tok say dem don write letter give pipo wey dem identify to invite dem come tok wetin dem know for di death of Mohbad.

CP Owohunwa add say anyone wey no show up after dem invite am, dem go place am for wanted list.

Di death of Mohbad don make some radio stations ban Naira Marley songs.

Splash FM for Ibadan, Oyo State and Fresh FM for Ado, Ekiti State don ban Naira Marley songs for dia stations till further notice.

Also di management of Ebonyi broadcasting Television-EBT following di Indefinite ban on Naira Marley songs bin also order immediate evacuations of Marlians Albums for dia studio!

Di management add say any staff wey by mistake or by chance play Marlians songs for dia studio go chop without pay, and dem go prosecute am.

Invicta FM don also ban Marlian Records for dia airwaves.

One statement dem issue tok say,“In light of current details wey dey comot from di death of di artist wey pipo sabi wella as Mohbad, Invicta98.9 FM don stop to dey give airtime to any song by any artist from Naira Marley record label.”

Mohbad biography

Wia dis foto come from, Mohbad/Twitter

Di singer, wey call himself « Imole » – di Yoruba word for light, dey married and e get one five-month-old son.

E begin make name for himself for 2019, thanks to im streetwise, sometimes lewd, relatable lyrics.

Fans love im unique baritone voice – e dey popular for im hit singles KPK (Ko Por Ke) and Ponmo, wey feature musicians Lil Kesh and Naira Marley.

E bin dey wit Marlian Records for about two years, anti-drug enforcement agents for February 2022 raid im house.

Dem catch MDA drug and cannabis for im and oda musicians possession but dem no charge dem.

Afta e fall out wit Marlian Records, e allege say dem deliberately dey sabotage im tours – sometimes organisers go cancel am for last minute.

For June, e file petition to police for Lagos and allege say Samson Balogun, one music promoter wey dey popular as Sam Larry, lead one group of armed men to interrupt onevideo shoot.

MohBad allege say dem bin assault am and destroy some of im equipment.

Oga Larry don deny di allegation and police tok say MohBad no follow through wit di case. Di music promoter don since comot hand say im no dey involved for di mata, e say him and di singer dey on good terms.

Videos of MohBad complaints about im relationship wit Marlian Records don show for social media since im death.

Dis don lead to sorrows, pain and ginger from im fans to know more about how e take die.


Crédit: Lien source

Les commentaires sont fermés.